I Built a Relationship AI That Speaks Pidgin, Yoruba, Igbo and Hausa
I build this app solo for seven weeks, and e don land for Play Store. The idea simple: person wey dey vex no dey first translate their feelings into English. Na the language wey dem know dem dey use talk. But most relationship apps only understand English, so users first need translate themselves before dem fit get help. That one no make sense to me. Three things hard pass the AI work itself: getting Nigerian voices to sound natural, fixing microphone input across the four languages, and making sure language links open in the correct language. I also design am so e no go label anybody narcissist, tell person to leave or stay, or pretend say e be therapist. I wan hear wetin fit break am and wetin I get wrong, especially for the Pidgin.
Stories are shared by community members. This article does not represent the official view of NaijaWorld — the author is solely responsible for its content.

