That Crazy Little Chicken!

17

(That crazy little chicken) abeg wetin be this? I tell una say me and my guy half kilo bounce enter one restuarant make dem dey call that crazy little chicken. I tell una say here fine die and very quiet. Naso we bounce go order for some drinks and snacks, i tell una say we no believe one niggar make dem dey call eskelenje carry beans and bread from house enter the restuarant go sidon dey chop. Chaiii the thing really vex the owner of the restaurant die, which kind useless person be this one self? This guy no get home trainning abi wetin self? Before we know naso the owner go meet the guy, please sir we dont condole this madness here, please find else where and eat this your local man food not in this place please. Naso eskelenje tell the owner of the restuarant, na mallam you dey tell, i dey come laugh won kill people which kind eskelenje be this one self? I tell una say eskelenje no even answer the owner of the restuarant again, baba bone face dey chop the food like who don first craze before. Chaiii the thing vex halfkilo die, naso halfkilo tell eskelenje. See come eskelenje as you carry face so like wolfsburg football club dey chop for here like madman cousin so, inshort you dey very stupid and hopeless, this one you dey answer eskelenje like person make dey suffer from sickle cell so, i dey very sure say na for under bridge you dey live fool. laugh won kill everybody chaiii my belle ooo. Oboy we no believe eskelenje answer halfkilo. See come halfkilo, as you keep neck like cripple he goat order for drinks and snacks like say na you rich pass, i dey very sure say if you and this useless baba olowo make keep head like traffic light chop this snacks finish na to find the nearest window fly run dey go house. everybody burst laugh chaiii wetin be this? I tell una say the thing really vex me baba olowo die. Naso i tell eskelenje. See come as you do face like indian mad cow make just go do surgery so. Na you and your family members dem nahim go chop finish fly window run dey go house. As you carry yansh so like portiphers wife make won nearly seduce joseph for bible so. everybody burst laugh, we no believe one guy laugh sotey the guy shout. I don die ooo, abeg how eskelenje make be man go get yansh like portipher wife make be woman? the guy laugh sotey people tire am rope troway go outside for streets. my belle ooo. As people still dey laugh dey catch fun naso two people bone face serious die enter the restuarant, oboy i tell una say na small thing everybody make dey inside the restuarant for pick race run dey go house, chaiii we even think say na sars men be that, we no even know say na the newest crazy couples in town, centino and the new bride, i tell una say their two bone face no even greet anybody waka go order for food. Naso centino tell the waiter, We need fried rice and chicken missed with pepper sauce and salads, then top it up with cold fanta juice, please make it two plates thanks naso dem bone face again go sidon for near window dey discuss. Chaiii the thing pain halfkilo die, naso halfkilo shout, see come centino and this new bride make keep chest like dry plastic plate so, so for una two village dem no dey teach una how to greet una elders abi? As the two of una keep face like youngzubi strong morning wood so. Na una type suppose dey farm dey suffer dey plant ugu leafs. As una carry teeths like pest control. everybody burst laugh i don die ooo. We no believe centino answer half kilo. Am really sorry for not greeting you sir, but you never told me you are way older than me and you are not yet married. My apologies sir, laugh won kill everybody so halfkilo don really old self? chaii this halfkilo make do face so like evil old vessel never even marry self. halfkilo no be small pikin again ooo, baba don old die. my belle ooo. I tell una say the thing really pain halfkilo enter soul, Baba won cry we no believe eskelenje shout, nice one there centino thats why i really love you. You are the best when it comes to simple fools like this. laugh won kill people chaiii na halfkilo be this? Naso centino talk again, as for you baba olowo d bend prick, dont go and marry, be there shifting girls waist with that your expired long thing like someone who was brought up from a polygamous crazy home. everybody burst laugh i don die ooo, people shout, baba olowo na today be your turn to chop better yab to think about your useless life there fool. chaiii wetin be this? I tell una say the owner of the restaurant laugh sotey him give dem centino free food no gree collect money. I tell una say the owner of the restaurant laugh shout, i have been waiting for ages for someone to stand up and challenge you this stupid baba olowo and this halfkilo of chicken. i don die ooo my belle ooo!

Use The App To Win N1m

NB: Stories are shared by community members. The article does NOT represent the official view of NaijaWorld and the author is SOLELY RESPONSIBLE for this article
Comments

Related Stories
thumbnail
5 Phrases You Should Never Say to Your Partner
7 d
thumbnail
After Seven Years on the Run, EFCC Nabs Notorious Lagos Romance Scammer
8 d
thumbnail
Why I Married My Tenant After My Wife Locked Me Out
8 d
thumbnail
“I Met IVD at His Lowest” – Blessing CEO Sets the Record Straight
11 d
thumbnail
Chiefs’ Next Power Couple? Gracie Hunt and Derek Green’s TikTok Romance Goes Viral
11 d
thumbnail
Trauma Bond or True Love? The Blessing CEO & IVD Marriage Dilemma
11 d
thumbnail
Timini Egbuson Reveals He’s Single After Three Years, Not a Womanizer
12 d
thumbnail
Nollywood’s Damola Olatunji Proposes to Mystery Woman in Viral Video
12 d
thumbnail
When Your Partner’s Twerking Videos Are for Everyone, Not Just You
14 d
thumbnail
Love Isn’t About Expensive Rings or Dubai Trips
14 d
thumbnail
Celebrating My Wife: From Queen to My Messiahness
15 d
thumbnail
Women, Don’t Underestimate a Man Just Because He’s Broke
15 d
thumbnail
When She Walked Away: Losing Something Money Can’t Buy
16 d
thumbnail
Do You Have to Kneel to Propose? Culture, Respect, and Reality
17 d
thumbnail
Beyond Sex: Why Married Couples Still Cheat
17 d
Related Stories
thumbnail
5 Phrases You Should Never Say to Your Partner
7 d
thumbnail
After Seven Years on the Run, EFCC Nabs Notorious Lagos Romance Scammer
8 d
thumbnail
Why I Married My Tenant After My Wife Locked Me Out
8 d
thumbnail
“I Met IVD at His Lowest” – Blessing CEO Sets the Record Straight
11 d
thumbnail
Chiefs’ Next Power Couple? Gracie Hunt and Derek Green’s TikTok Romance Goes Viral
11 d
thumbnail
Trauma Bond or True Love? The Blessing CEO & IVD Marriage Dilemma
11 d
thumbnail
Timini Egbuson Reveals He’s Single After Three Years, Not a Womanizer
12 d
thumbnail
Nollywood’s Damola Olatunji Proposes to Mystery Woman in Viral Video
12 d
thumbnail
When Your Partner’s Twerking Videos Are for Everyone, Not Just You
14 d
thumbnail
Love Isn’t About Expensive Rings or Dubai Trips
14 d
thumbnail
Celebrating My Wife: From Queen to My Messiahness
15 d
thumbnail
Women, Don’t Underestimate a Man Just Because He’s Broke
15 d
thumbnail
When She Walked Away: Losing Something Money Can’t Buy
16 d
thumbnail
Do You Have to Kneel to Propose? Culture, Respect, and Reality
17 d
thumbnail
Beyond Sex: Why Married Couples Still Cheat
17 d