Tailor, Seamstress or Fashion Designer: Wetin Dem Mean?
Make we clear this small. Tailor na the OG. Give am your material and style, e go sew am quick with sharp finish. No extra talk or drama, just fitting and ready. Seamstress na like tailor cousin wey dey focus on neat finishing. Dem dey do small corrections and make sure cloth sit your body like second skin. Fashion designer na CEO of vibes. From sketch to runway, dem dey create fresh styles you never even know say you need. Next time no go carry copy-paste Ankara gown go meet designer come dey charge as pure tailoring. Respect every lane – needle work no be beans! Who you go meet for your next outfit?
Stories are shared by community members. This article does not represent the official view of NaijaWorld — the author is solely responsible for its content.

