Celebrities Are Human Too: Let Them Choose When to Speak
Make we talk true. Una dey always drag celebrities for not speaking up. But una don see how dem maltreat Mr Macaroni when he used voice to speak for everybody. People mock and insult am just because e open mouth. No be everybody get motivation to talk. Some celebrities no like politics. You fit no dey interested too. We gats accept say celebrities are humans like we be. Abeg, make dem choose whether dem wan speak or stay silent. If dem wan collect 10 million, sing campaign song, japa to Caribbean island, no wahala. E better pass to dey speak for people wey go collect rice and indomie and forget you.
Stories are shared by community members. This article does not represent the official view of NaijaWorld — the author is solely responsible for its content.

